Victor AD Wetin We Gain lyrics

Intro

Red Eye yeah yeah

Bros if you no love am, wetin you gain

It’s Victor AD nah nah nah yeah

Pray for grace ma gee

I say pray for grace ooo

Pre-Chorus

Oluwa ma gba gbe mi

I wan chop dis money

No wan take d same step wey I take last year

Wey no work for me ohhh

Lord!

As I dey grind I dey hustle

Bless me wit this money

Baba na ur hand I dey

I say make u run am for me oh

Chorus

If we no make money

Wetin we gain ohhh (Wetin we gain)

My broda wetin we gain (Wetin we gain)

If we no buy d Benz

Wetin we gain ohhh (Wetin we gain)

Omo na wetin we gain (Wetin we gain)

If we no get control

Wetin we gain ohhh (Wetin we gain)

Omo na wetin we gain ohhh (Wetin we gain)

If we no make money

Wetin we gain ohhh (Wetin we gain)

Omo na wetin we gain ohhh (Wetin we gain)

Verse 1

Lord u know wetin me and u don talk

Make e manifest oh Baba

Ah, the streets na by grace

No b who hustle pass dey carry first oh

Na your grace I take dey live

I no fit play attack and defense oh, at the same time

And I thank you Lord say even wen I dey cast

You still give me the talents

And the gift make I pass eh

Hook

Phone dey ring

Na family dey call oo

If no b billing

Na something dey sup oo

Anyhow e be omo money is involve oh

Oluwa bless me cos I no fit dull oh

So much pressure on a mere figure

I say in dollar I still want that 10 figure

I need d kind of money wey go make Dangote say

Who b dis black skin man wey dey worry am eh

Repeat chorus

Verse 2

This year I want to buy motor

This year I want to buy house

This year I dey pray make Oluwa no pass me by

Cos I pray for grace ma gee

It’s not written dat u will find all you seek

But u will never find that which u did not seek

Omo this shit is deeper than life

It’s not for d shallow mind

As we still dey, dey grind eh

Repeat hook

Repeat pre-chorus

Repeat chorus

Comments

Popular posts from this blog

The Newell Murder serialization 1